God Ahbeg!
Inside this poem, a final year student poured out his fears, moods, worries and hopes as the university management begins the moderation and releasing of last semester results after eight months Hussein Nuhu Isa (SonOfNuhu) My heart dey beat like say tiff wey just shoot person point him gun to my head Like say na grandma dey try focus to put thread for needle, if you see di way my hands dey shake Man wey di parade for hospital ward as im dey wait for im new wife wey wan born twin for di first time to come out of di labour room no get worry like me Di kain worry wey full my mind fit mek person waka pass better days for ahead junction mek e no even notice, ahswear! All di white hair for Wole Soyinka head no fit reach di number of black thinking wey gather dey sing 'e don red oh brother" for my mind Aswear! If you pinch me or tear my body now with razor blade, blood fit no comot wit di way I no just bi myself Aswear! No amount of ice block of motivational qu...