God Ahbeg!

 

Inside this poem, a final year student poured out his fears, moods, worries and hopes as the university management begins the  moderation and releasing of last semester results after eight months


Hussein Nuhu Isa (SonOfNuhu)



My heart dey beat like say tiff wey just shoot person point him gun to my head


Like say na grandma dey try focus to put thread for needle, if you see  di way my hands dey shake


Man wey di parade for hospital ward as im dey wait for im new wife wey wan born twin for di first time to come out of di labour room no get worry like me 


Di kain worry wey full my mind fit mek person waka pass better days for ahead junction mek e no even notice,

 

ahswear!


All di white hair for Wole Soyinka head no fit reach di number of black thinking wey gather dey sing 'e don red oh brother" for my mind


Aswear!


If you pinch me or tear my body now with razor blade, blood fit no comot wit di way I no just bi myself


Aswear!


No amount of ice block of motivational quote fit calm my hot worry worry head as I dey now, becos even fear dun dey fear me with di way dis matter carry fear dey fear me.


Aswear!


To pray dey do me but like small pikin wey shit dey worry for inside big party wey mama wey carry am come di stage dey dance ,weytin I wan talk?, how I wan take pray di prayer?.


But I come remember my mama word wey say "na person wey no fail to become failure dem go lass lass call failure".


So I try open my mind plus my mouth again and again to pray but weytin come out na "God Abeg" as I siddon with phone for hand dey wait mek di students portal page load finish make I check my last semester results.



God abeg! any carry over now na spilling,


God abeg!! Spilling na additional year on top Corona and ASUU strike


God abeg!!! Another year fit enter another and another  other year and mama di wait to see one of her pikin to becom graduate from di university.

Comments

Popular posts from this blog

An Open Letter to My Vice Chancellor: Utilizing Publicity to Showcase the Creative Excellence of Our Exceptional Students

Inside UDUS: NUASA-UDUS Sets To Hold Congress Meeting

NACJ-UDUS Congress: Editorial Training Takes Center Stage